10-06-2017, 06:02 PM
President Donald Trump don describe di gunman wey kill 59 people, still injure another 527 inside Las Vegas on Sunday as man wey "sick and dey demented."
President Trump mean say di man no dey with im correct sense.
Im bin dey speak for di White House; im say e go put eye for di country gun laws "as time dey go" but im no talk pass so.
Police don identify di gunman as 64-year-old Stephen Paddock, wey open fire begin kill people anyhow for concert - im bin dey shoot from di 32nd floor of di Mandalay Bay Hotel.
Police say di suspect kill imself before dem fit reach im hotel room.
Dem don find 23 guns for im hotel room, as well as "wetin plenty pass" 19 firearms and explosives for im Nevada house.
But as e be now, no clear reason dey for di killing. Dis na wetin police dey try find out.