09-16-2017, 12:33 PM
Nigeria President, Muhammadu Buhari, go comot Nigeria on Sunday, September 17 go New York and London.
One statement wey di office of di president release, on Friday, talk say President Buhari dey travel go New York, US, go attend di United Nations General Assembly, come branch for London, UK.
But dem no talk wetin di President dey go do for London and how many days im go spend there.
Di statement talk say President Buhari go do one meeting with UN Secretary General, Antonio Guterres, for New York.
Image copyright Bayo Omoboriowo/ Aso Rock Villa Image example President Buhari dey go America for UN meeting
Im go also do meeting with US President, Donald Trump.
President Buhari dey go US with Governors of Zamfara Ebonyi, Ondo states and some ministers but dem no talk who dey follow am go London.
Di last time wey President Buhari travel go London, na for medical reasons and im no return to Nigeria until Saturday, August 19, over three months after im comot.