08-22-2017, 11:23 AM
Many Nigerians wey talk on top BBC News Pidgin Facebook, on Monday, no too dey happy with Kogi State governor, Mr. Yahaya Bello sake of say im declare Monday as public holiday in di state over di return of President Muhammadu Buhari.
After over 100 days in London where im dey on medical vacation, President Buhari return to Nigeria on Saturday, August 19. Im address di nation on Monday morning, come send letter to di National Assembly say im don resume work.
But as di President dey say im don resume work, Mr. Bello declare holiday for Kogi State and Nigerians dey react to this kain thing on BBC News Pidgin Facebook page. Na wetin some dem talk be this.
SOURCE:BBCPIDGIN