08-27-2018, 07:56 AM
Wenger dey helep plenti African players for dia career
Liberian president George Weah don give former Arsenal coach Arsene Wenger di highest award for di kontri.
Di award na "Knight Grand High Commander of di Humane Order of African Redemption".
Dis na sake of di way di French man dey take helep African football players. Na Wenger buy Weah go Monaco wen im dey start im football career.
Di coach wey bin tell Wenger say Weah get talent Claude Le Roy also collect di award. Im be coach of Togolese national team.Former Ghanaian President John Kuffour chats with Wenger
Dis na some pictures from di award ceremony.
Former Ghana president John Kuffour dey tok wit Wenger
Weah bin tok before now, say Wenger "take care of me like im son" wen i go Monaco. E say apart from God "witout Arsène, e no get any way I for fit make am for Europe".
Wenger wey bin sign George Weah for 1988 wen im be coach for Monaco, step down for May dis year as Arsenal manager afta 22 years wey im don train different African stars.
But no be evribodi for di kontri dey happy say Wenger collect award for di personal tin im do for di president, say no be like dat e suppose be, according to wetin BBC tori pesin Jonathan Paye-Layleh hear.
Di award no be just for di personal connection between president Weah and Wenger, di Information Minister tok - na also to recognise say Wenger "don contribute well-well to sports for Africa and im don give many Africans opportunities".
President Weah, na di only Africa wey dem don name World Player of di Year and im retire from football for 2003 to enta inside politics. Im replace Ellen Johnson Sirleaf as president afta election dem do for early 2018.
Weah bin tok before now, say Wenger "take care of me like im son" wen i go Monaco. E say apart from God "witout Arsène, e no get any way I for fit make am for Europe".