The following warnings occurred: | ||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||
Warning [2] Undefined array key "avatartype" - Line: 783 - File: global.php PHP 8.0.30 (Linux)
|
Monkeypox virus don hit Bayelsa - Printable Version +- Forums (http://contripeople.com) +-- Forum: Retired Forums (http://contripeople.com/forumdisplay.php?fid=78) +--- Forum: Retired Forums. Please Make Your Post Within The 3 Forums In General Discussion (http://contripeople.com/forumdisplay.php?fid=49) +---- Forum: Medical Science (http://contripeople.com/forumdisplay.php?fid=67) +---- Thread: Monkeypox virus don hit Bayelsa (/showthread.php?tid=337) |
Monkeypox virus don hit Bayelsa - samxpress9 - 10-06-2017 Up to 10 people dey quarantine for Niger Delta University Teaching Hospital for Bayelsa State, south-south Nigeria, after dem get wetin be like monkeypox. Di Nigerian Centre for Disease Control (NCDC) and di epidemiological team for Bayelsa State ministry of health dey also chook eye on to 49 people wey dem believe fit get di virus after dem come in contact with some of di people wey dey infected. Na Bayelsa State commissioner for health, Professor Ebitimitula Nicholas Etebu, confam di tori plus e say dem don carry sample of di virus go World Health Organisation (WHO) laboratory for Dakar, Senegal make dem true-true confam say na monkeypox. Wetin be Monkeypox? According to WHO, Monkeypox na one kind virus wey no dey very common and e be zoonosis - dat one be say na from animal wey e dey affect human being. E get symptom wey resemble smallpox but e no dey as serious. Some other things wey you suppose know about Monkeypox:
|