09-01-2018, 11:51 AM
Hello my fellow contripeople, "happy weekend and happy new month to all of us" This new month go sama us with beta beta things.
This week na very interesting week...... and i go like fresh una mind with all the things wey don happen inside this week.
This week na him THERESA MAY wey talk say the capital of Nigeria na poverty enter Nigeria. I dey sure say that her bad impression about we contri Nigeria go don change by now.
Na this same week SARAKI declare say we youth tell am say make him go represent us for presidential election.
Still this week na him ANGELA MERKEL enter Nigeria come visit us so. Na this same week DAVIDO surprise all of us with NYSC khaki say him don be youth corper by fire by force; say make dem allow am too follow serve him papa land.
Abeg make i ask, Davido go follow collect the 19,500 NYSC allowance? Him go follow dey sleep for camp abi na from house him go dey go the camp?.
The way all the officials dey snap pisure with am so, una go think say na president enter the camp.
Shey una don see say this week dey interesting well well and all the detailed tori wey happen this week dey on top this forum http://www.contripeople.com
Make una search, read and una go enjoy am.