11-16-2017, 10:12 PM
*I just dey house with my brother dey relax the next tin wa we hear na noise for our compound when we come outside, we see say na our next door neighbor dey fight over an unclear issue.One na graphic designer the other one na olosho (sex worker) watin be their matter no body know.Na so one girl for the compound come ask the guy watin make am dey fight the girl the guy say nothing dem ask the girl, the girl say nothing. Ok o if na so Una talk make Una stop to dey fight over nothing but the landlord no wan hear say na nothing dey make them fight so e go call police for every body.Na so matter take change o for police station na there we for know say na "blow job" dey cause the fight the guy come talk say the girl dey hold am money because say e pay the girl sex and the the girl come make am high forget himself but the girl say na lie say dey do the thing but she no give am blow job after everything no be that one bey even dey pain me sef the guy na our compound pastor for night e no go let us rest with prayer after that one him go go cool off with one olosho.*