10-06-2017, 12:03 PM
Up to 10 people dey quarantine for Niger Delta University Teaching Hospital for Bayelsa State, south-south Nigeria, after dem get wetin be like monkeypox.
Di Nigerian Centre for Disease Control (NCDC) and di epidemiological team for Bayelsa State ministry of health dey also chook eye on to 49 people wey dem believe fit get di virus after dem come in contact with some of di people wey dey infected.
Na Bayelsa State commissioner for health, Professor Ebitimitula Nicholas Etebu, confam di tori plus e say dem don carry sample of di virus go World Health Organisation (WHO) laboratory for Dakar, Senegal make dem true-true confam say na monkeypox.
Wetin be Monkeypox?
According to WHO, Monkeypox na one kind virus wey no dey very common and e be zoonosis - dat one be say na from animal wey e dey affect human being.
E get symptom wey resemble smallpox but e no dey as serious.
Some other things wey you suppose know about Monkeypox:

- E dey happen for hard to reach parts for Central and West Africa.
- Di virus dey very serious for human beings.
- Just as animal fit pass am to human being, na so human being sef fit spread am by human-to-human transmission.
- E no get medicine to treat am and vaccine no dey.