The following warnings occurred: | ||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||
Warning [2] Undefined array key "avatartype" - Line: 783 - File: global.php PHP 8.0.30 (Linux)
|
Jenelle Evans Twerks in Front of Her Children in SUPER Cringey Video - Printable Version +- Forums (http://contripeople.com) +-- Forum: General Discussion (http://contripeople.com/forumdisplay.php?fid=5) +--- Forum: General Discussion (http://contripeople.com/forumdisplay.php?fid=60) +--- Thread: Jenelle Evans Twerks in Front of Her Children in SUPER Cringey Video (/showthread.php?tid=9570) |
Jenelle Evans Twerks in Front of Her Children in SUPER Cringey Video - Gimbiya - 08-26-2018 Abeg e make sense make mama dey twerk for her children front?
make i yarn una how the mata take be. E get one viral trend like that called "in my feelings" where persin go dey waka dey dance to drake song near motor wey dey move slow slow. Na so our anti Jennelle follow join for the trend.
As if that one no do na so she open the thing yakata in front of the children dem. To begin think say this na persin mama dey embarrassing somehow
If we wan come begin list the kind bad bad words wey don follow her mouth comot and the things wey she don do ehn, e go resemble those kind character for soap opera wey oyinbo people dey call "white thrash"
Na only her steal her mama credit card follow bobo go flex for New Jersey.
Na same her carry fowl feather hang for hair unto say she wan attend kesha concert.
Abeg my contripeople make we sofri dey do things for our children front becoz na wetin we dey do dem dey copy one twitter user advice her so.
her pictures dey under but i no upload the video sha as e no help anything.
RE: Jenelle Evans Twerks in Front of Her Children in SUPER Cringey Video - Edoman - 08-26-2018 No shame RE: Jenelle Evans Twerks in Front of Her Children in SUPER Cringey Video - Gimbiya - 08-26-2018 (08-26-2018, 02:06 PM)Edoman Wrote: No shame SHAME? WHERE SHE WAN SEE AM |